Family of Black Panther star Chadwick Boseman don drag im wife go court ova property mata

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Paul Glynn
- Author, Ian Youngs
- Role, Culture reporters
- Published
- Read am in 3 mins
Chadwick Boseman brothers don drag di late US actor widow go court on top how she dey handle im multimillion-dollar estate.
Derrick Boseman and Kevin Boseman don file petition wit one Los Angeles court to force di Black Panther star widow, Taylor Simone Ledward, to share money give family members, and make court remove her as controller of im estate.
Dem claim say she has mishandle di distribution of di money and she "no fit dey trusted to continue dey manage di estate".
Boseman bin die at di age of 43 for 2020, four years afta dem diagnose am wit colon cancer.
E dey remembered best for di lead role e play for T'Challa, king of Wakanda, in Oscar-winning 2018 Marvel blockbuster Black Panther.
According to court documents wey BBC News see, Boseman get assets wey worth $3.8m (£2.9m) but e die without a will.
One court come decide say make 50% go to Bosemans widow, who dem also appoint as di estate administrator, and 25% to each of im parents.
Di actor brothers bin file di court petition last week on behalf of dia parents, Leroy and Carolyn Boseman.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di petition Ledward tok say she "neva still distribute di estate" and "she continue to exercise unilateral control" ova am.
Dem also accuse Ledward say she create "lack of transparency" around im assets, and she keep di actor parents "in di dark" about di deals and operations of company wey dem set up to manage im image and rights.
Di brothers claim say Ledward "misconduct dey cause ongoing harm" to Boseman elderly parents and dey deprie dem "of financial assets for dia vulnerable age wen dat kain support dey most important".
"Moreover, di needless continuation of these proceedings dey deny di Decedent [Boseman] family closure and e dey cause emotional distress for dem," di court filing tok.
"Imagine flipping through di channels and you stumble on film wey feature your deceased son or brother, and you know say pesin wey you no know or trust dey profit from im image without your input or consent."
Ledward - wey be R&B artist wey dey use di name Sahn - begin date Boseman for 2015 and dem marry just six days bifor di actor death for August 2020.
BBC don ask her lawyer for comment.
For one statement to US media, di late actor brothers say: "On behalf of our parents, we dey committed to ensuring say transparency, accountability, and respect guide di resolution of these matters.
"Our hope na say dis process bring clarity, honour di court orders, and ensure di responsible stewardship of Chadwick legacy.
"We love our brother, and we remain committed to preserving im legacy wit dignity, integrity, and respect."















