You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria govment soft loans fit solve di kontri unemployment challenges?
Plenty reactions don follow Nigeria govment loan schemes for youths for di kontri and pipo wey no get collateral dem need to collect normal loans from bank.
Many Nigerians don hail di schemes as ogbonge initiative but worry as govment no disclose wetin di interest rates go be, and if e dey enough to solve di kontri unemployment challenges.
According to di Nigeria Bureau of Statistics, Nigeria youth unemployment rate for 2025 bin dey 5.34%, 0.25% increase from 2024. Dem neva release data for 2026.
On Wednesday 22 July, Nigeria govment bin launch di YouthCred for Entrepreneurs, one new credit scheme wey go allow gainfully employed Nigerian youths (18-39 years) to access affordable loans of up to ₦5 million through di Nigerian Consumer Credit Corporation (CREDICORP).
Di aim na to provide affordable loans for young business owners and improve dia access to get funds to finance dia business.
During di launch, di Minister of Finance and Coordinating Minister of di Economy, Taiwo Oyedele say dem design di loan scheme to provide between N200,000 and N2 million to 500,000 young entrepreneurs.
"More dan 90 percent of Nigeria micro, small, and medium enterprises dey built around individuals, from di tailor to di ride-hailing driver, di fashion designer, di caterer, content creator, di mechanic, and di young farmer, many no still be part of formal finance becos traditional lending dey always want incorporation evritime, audited accounts, and collateral for early stage entrepreneurs wey no get am and dem no go fit provide am.
"Through youth credit for entrepreneurs, eligible Nigerians wey dey age 18 to 35 fit access financing from N200,000 to N2 million, wey no dey based on wealth dem inherit or collateral, but na simply on responsible credit behavior, cash flow, and repayment capacity wey dem go get through regulated financial institutions", e tok.
Nigerian youths wey go benefit from dis loan fit choose how dem go pay di money back within one to 12 months. You no also need collateral or guarantors to qualify for for di loan.
Pipo wey fit apply include small business owners like caterers .fashion designers, ride -hailing drivers, make-up artists, content creators ,farmers wey dey young, mechanics, pipo wey dey do National Youth Service and oda pipo wey dey run samll business.
Govment say dem design di programme to help young workers overcome financial challenges, improve productivity, and build formal credit history without falling into di hands of loan sharks or unregulated lenders.
Like di YouthCred, Nigeria govment launch anoda one loan programme on Tuesday wey dem call di Nigerian Consumer Credit Corporation (Credicorp). Dis financing scheme na to provide consumer credits for young pipo.
Dis loan na for pipo wey get interest or wey dey do digital services to help dem buy laptops and oda digital devices for prices wey no too cost, as part of di Nigeria govment three million technical talent (3MTT) programme.
Di name of di programme na Credit for Laptops, Internet, Connectivity and Knowledge Digital Devices (C.L.I.C.K.D)
Na collabo wit di ministry of communications, innovation and digital economy for Nigeria.
Nigeria minister of communications, innovation and digital economy, Bosun Tijani say di program dey designed to designed to make sure say Nigerians get access to both digital skills and di tools wey dem need to participate for di digital economy of di kontri wey dey grow.
"Nigeria digital economy go only grow if our pipo get both di skills and di tools to succeed," Tijani tok.
Anoda one na di Youth in AgriBusiness Land Trust Fund - dis one according to President Tinubu tok-tok pesin on Youth initiatives Titilope Gbadamosi, na new opportunities wey govment dey give young farmers to access land, alongside di practical support dem need to build sustainable agricultural enterprises.
'Na one of di best tin wey go happun to Nigeria youths' - Political analyst
Wit dis back to back programs wey Nigeria govment don launch to develop young pipo for di kontri, e go help di unemployment crisis wey Nigeria dey face ova di years?
Political Analyst Sani Bala chook mouth as im try to ansa di question. E say govment don do well to come up wit dis kain opportunities for young pipo and Nigeria youths get plenti talents.
"Plenti youths dey for dis kontri wey get talents beyond wetin any pesin fit imagine for di world. Dem dey contribute well-well to nation building and for our govment and pipo to notice, na beta tin.
E tell BBC Pidgin say one beta example na di GSM Market for Kano and oda big markets wey young pipo dey use dia digital skills dey work, and dis kain support go go a long way.
"For me na one of di best tin wey go happun to Nigeria youths, to give dem contribution to build or generate capittal to start up sometin or to develop wetin dem bin don already start, na beta initiative."
Im also raise concern about support programs like dis wey no succeed in di past sake of mago-mago and how officials dey use di opportunities anyhow dem like.
"But di oda part of our main concern na say Federal govment workers dey sometimes abuse dis kain of project.
Some pipo dey heartless, dem fit use one way or the other to bring di project down.
If Nigeria govment fit tell di anti-corruptions agencies for di kontri to put eye ontop dis project, I think say dem fit do sometin.
Govment fit use civil society organization to do collabo so dat transparency go dey and accountability to handle dis type of projects and initiative"
Some empowerment programes for Nigeria
For Nigeria almost evri administration dey come wit dia own empowerment programs for youths, farmers, and oda fields to address di issue of unemployment.
Empowerment programs like Npower, Trader Moni bin dey under di late and former President of Nigeria, Muhammadu Buhari.
President Bola Tinubu administration start wit di Access to Higher Education Act wey dem sign into law.
For April 3, 2024 oga Tinubu bin sign di re-enacted Nigerian Education Loan Fund (Nelfund) bill wey bin establish how e go work.
For May 24, 2024: Di Nelfund student loan application portal bin open officially for students to submit dia applications.
Even though small wahala bin dey recently wit di student loan, Nigeria govment don resume payment.
Wit all dis interventions pipo still dey complain of unemployment and how businesses dey struggle.
Dis two new initiative go get any impact? make we see as e dey go.