India 'cockroach' protesters call off strike as education minister Pradhan resign

Wia dis foto come from, Getty Images
India Education Minister Dharmendra Pradhan don resign afta weeks of protests on top exam papers wey leaks and testing irregularities.
Di resignation come afta weeks of demonstrations by di Cockroach Janta Party (CJP), one social media banta wey bin as joke bifor e expand into one big campaign wey dey call for accountability and education reforms.
Pradhan bin announce im resignation on X for one post, just hours bifor di third round of toks between di govment and di Cockroach Janta Party (CJP).
"I hold deep respect for di aspirations, sentiments, and rightful expectations of di youth of dis kontri. Realising di dreams of India young generation na di moral resolve of our political and social life," e write.
Prime Minister Narendra Modi don accept Pradhan resignation earlier on Saturday. Di govment neva announce who go replace am as minister.
Protesters don continue to gada for Delhi Jantar Mantar – di main protest site – as many of dem dey celebrate wetin dem see as major victory.
One activist Sonam Wangchuk, wey bin dey di centre of di protest welcome di education minister resignation and call am "victory of democracy".
For one post on X, e hail di CJP, Gen Z and all citizens "for shedding fear and di fear of fear and as dem rise up from evri corner of di nation".
End of Di one wey oda users dey read well well
Wetin bin start as a student-led campaign against alleged exam paper leaks bin turn one of India biggest displays of public dissent in recent years, as thousands of young pipo camp for Delhi and demonstrations spread across di kontri.
Rahul Gandhi, di leader of di opposition for parliament, call Pradhan resignation a "major step towards revamping our education system".
"Heartiest congratulations to evri young pesin and student wey take to di streets and stand firm to protect democracy, di constitution, and dia own future," e write for X.
Gandhi say make di Prime Minister Narendra Modi apologise to di students and make di govment take action against dos wey dey responsible for violence against protesters.
Wetin be di Cockroach Janta Party?
Di CJP bin start as one of India biggest youth protest movements, even though e no be political party.
Dem form di group afta di chief justice of India compare some unemployed young pipo to "cockroaches".
E later say im bin dey refer to pipo wey get "fake and bogus degrees", but by then, di term don get a life on its own.
Many young pipo wey dey frustrated by rising unemployment and irregularities for competitive exams - embrace am, dem turn di insect into one symbol of defiance and resilience.












