Anti-immigration Police operations and death of Nigerian for South Africa cause gbege

Wia dis foto come from, RAJESH JANTILAL / AFP via Getty Image
One Nigerian national, Ibeh Chika Simon don kpai for South African police hand for one South African Police Service Operation wey happun for 23 July for Cape Town.
Dis informate dey come from di Consulate General of di Federal Republic of Nigeria for Johannesburg wey condemn im death wey dem bin call say happun under "questionable circumstances".
For office of di office of di Consulate General, dem tok say "we dey deeply appalled by tori of di shocking police tactics wey cause im death plus including di shooting of anoda Nigeria, Egwabor Patrick Chuks wey still dey in treatment wit plenti injuries".
Dis na di second death of Nigerian for police hand wey dey confam since South Africans start to protest say make foreign Africans comot dia kontri.
Na di Nigerian Foreign Ministry bin loud dat issue say police officers for Tshwane Metro Police kill Emeka Charles Iroegbu for Pretoria on 28 June "using gruesome interrogation techniques".
Dem say for 28 April dem still kpai anoda Nigerian, Nnaemeka Ekpeyong. and di Ministry add say, "Im case still dey pend, dem no make any arrest, even though di four officers wey dey involved dey known to di South Africa Police Service (SAPS)".
Di Consulate reason di mata say "inside di growing afrophobic sentiment, dis kain tin show disturbing disregard for right to life, dignity and due process wey di South African Law Stamp for all human beings."

Wia dis foto come from, Per-Anders Pettersson/Getty Images
Videos of di mata as oga Simon dey kpia show wetin look like say police dey strangle am.
Howeva, di Western Cape police tok say Simon bin kpai "wen e ebin dey placed under arrest as e bin allegedly start to sick and come collapse".
Dia tok-tok pesin Col Andre Traut tok ay di officers bin dey do search for house for one area wen dem find unlicenced firearm and wetin bin resemble drugs.
Di first results wey comot from post mortem vim show say di 42 year old Ibeh Chika Simon "bin get plenti bruises and abrasions for im back and chest". Dis na based on wetin one independent bodi wey dey chook eye put wetin police dey do tok.
As to di mata of di man wey police dey accused say dem shoot, Egwabor Patrick Chuks, di Western Cape police tok say dem be "no record of dat mata say e happun"
All dis dey happun as plenti Africans don dey try to comot dia citizens from di kontri following deadline of 30 June wey di protesters against immigration give immigrants for di kontri.
Even sef di mata don pass govment to tell South Africa to investigate dis killings.

Wia dis foto come from, GHANA FOREIGN MINISTRY
So far Nigeria don carry ova 1,400 Nigerians don run come bak to Nigeria since di latest xenophobic attacks on Africans start again for di kontri.
Dem come bak in seven batches of flight wey di Nigeria govment arrange, according to wetin Vice President Kashim Shettima, tell di Ecowas Authority of Heads of States and Govments on Sunday, 19 July.
Ghana authorities don alreadi carri ova 1,000 pipo for early June and dey plan to comot 1,000 more within di week.
Dis na as Ghana still dey do investigatgion inside one of di kontri pipo wey kpai for South Africa just bifor di 30 June nationwide anti-immigration protests.
Govment officials say di death of Bashiru Isak dey linked to di current wave of xenophobic attacks for South Africa even though police for di rainbow kontri say di death dey related to 'extortion".
Inside one statement from Ghana foreign ministry, dem confam say "dem shoot Bashiru wey be law-abiding father of three, multiple times for Khayelitsha, a suburb of Cape Town, contrary to false claims by some South Africa officials".
South Africa say dem don arrest ova 1,200 suspects including 159 undocumented foreign nationals wey dem say go against di immigration act.
South Africa police say dem pack di undocumented foreign nationals for Gauteng province of South Africa during dia operation shanela.
Di arrest dey come weeks afta di rainbow kontri carry out one of dia biggest crackdowns on undocumented migrants in years, following weeks of anti-immigration protests wey see violence, intimidation and looting.
However, di police no tok di nationality of dose wey dem arrest or wetin go happun to dem.
Chairperson of di Inter-Ministerial Committee on Migration, Nkhensani Mmamoloko Kubayi tok say between 14 June to 24 July, dem don process and deport a total of 68,138 foreign nationals of various nationalities.
She announce di informate on Sunday, 26 July during one press briefing to update South Africans on how di govment dey implement di 'Five-Point plan' to strengthen migration management for di kontri.
How diplomatic channels wan handle dis South Africa immigration kasala
Two Ghanaians don petition di international Criminal Court (ICC) to chook eye for di xenophobic attacks against foreign nationals for South Africa.
According to dem, dis attacks wey don cause deaths, injuries and looting of shops be crime against humanity, under Article 7 of di Rome Statute.
Dr Palgrave Boakye Danquah wey be ex-Ghana govment tok-tok pesin on governance and security togeda wit security sabi pesin Emmanuel Kotin, bin petition di ICC on 15 July, wey dem demand among oda tins say South Africa authorities gatz take serious action now.
Inside di petition to di office of di prosecutor of di ICC for di Hague, Dr Palgrave and Emmanuel Koti say "di ICC gatz begin preliminary examination into di repeated xenophobic attacks for South Africa wey cause illegal killing s, assault, displacement and destruction of property wey belong to civilians and foreign nationals especially African migrants."
Dia three-point call for di ICC
- Preliminary examination of di situation for South Africa
- ICC gatz summon and question President Cyril Ramaphosa and oda senior govment officials ova dis mata
- Ensure accountability to stop more violence
According to Reuters, one tok-tok pesin for South Africa foreign ministry say di petition be opportunistic, wia im tok say e fail to meet di legal jurisdictional requirements for di ICC to act.
Di ministry toktok pesin Chrispin Phiri say "South Africa get sophisticated and domestic legal framework" wey dia laws dey provide comprehensive solution and enforcement against discrimination, intolerance and odas.

Wia dis foto come from, Bola Tinubu/John Mahama/X
Meanwhile di govments of Nigeria and Ghana don condemn di xenophobic attacks against Africans for South Africa, and call on members of di Economic Community of West African States (Ecowas) to dey united to confront am.
Presidents Bola Tinubu and John Mahama of Nigeria and Ghana respectively, tok dis one for dia speeches during di 69th Ordinary Session of di Ecowas Authority of Heads of State and Government, for Freetown, Sierra Leone, on Sunday.
Di Minister of State for Foreign Affairs, Amb. Sola Enikanolaiye and di Minister of Foreign Affairs of Ghana, Hon. Samuel Okudzeto Ablakwa bin hold bilateral meeting for di ongoing ECOWAS Mid-Year Summit for Freetown, Sierra Leone, on Friday, 17 July 2026.
Dem tok say dem make sure say Afrophobia dey di agenda for di next African Union Summit to ask for stronger mechanisms for inside di AU to handle di mata.
"Nigeria condemn in di strongest terms, di recent attacks on dia citizens and oda Africans for di Republic of South Africa," Vice President Kashim Shettima, wey represent President Tinubu for di meeting, tok.
"Ecowas must to present a united voice for dis condemnation and table di mata bifor di next session of di Authority of Heads of State and Government of di African Union. Dis go send clear message say dis type of intolerance dey totally unacceptable under any guise.
"South Africa suppose dey reminded say di freedom wey dem dey currently enjoy na di result of di sacrifices and liberation efforts of African kontris, including Nigeria."








