South Africa warn against door to door search of migrant documents as Ghana evacuate 1,000 more citizens

Ghana national for plane as dem comot for South Africa sake of anti-migrant protest

Wia dis foto come from, Ghana Foreign Affairs Ministry/X

Published
Read am in 1 mins

About 1000 Ghanaians wey dey live for South Africa dey expected to land Accra Ghana on Sunday, 26 July and Monday, 27 July, as part of govment effort to evacuate dia citizens from di rainbow kontri sake of anti-immigration protest.

Dis dey come as South Africa govment warn groups wey dey conduct door to door search of foreigners documents to stop, as e dey affect dia work.

On Saturday, Ghana minister of foreign affairs Sam Okudzeto Ablakwa for statement announce say dis latest evacuation phase go be in groups.

"Dis evacuation exercise na for pipo wey don already register wit di Ghana High Commission for Pretoria to voluntarily leave di kontri," di minister tok.

E say dem no go abandon any national wey wan comot for South Africa and leave am for di way of harm.

"Di govment of Ghana and our high commission for Pretoria remain alert and don reactivate dia emergency consular response as we tanda ready to assist all Ghanaians wey dey live for South Africa to return home safely."

For June, di kontri bin repatriate nearly 1,000 pipo South Africa sake of xenophobic attacks and harassment against African nationals.

Ghana be one of di first kontris wey begin to repatriate dia citizens afta fresh wave of attacks for South Africa.

Later, Nigeria, Zimbabwe, Malawi, Ethiopia, Kenya and oda kontris follow for di repatriation exercise to evacuate dia citizens from di kontri.