Nigeria longest reality show return wit new twist as dem unveil housemates

Published
Read am in 5 mins

Popular Africa reality show, Big Brother Naija alias BBNaija don return wit di 11th season as dem begin unveil di housemates.

MultiChoice Nigeria announce say dis new season go start on Sunday, 26 July wit di theme, "Everything is for di taking."

Di organisers say di theme mean say housemates go need earn "evri task, evri alliance, evri vote, and evri decision to remain for di house and di housemates wey understand dat from di first night go be di ones wey go still stand wen e mata di most."

Dis season winner go walk away wit record breaking price of ₦160 million-naira grand prize, wey include a cash sum of ₦100 million plus one brand-new SUV.

Di prize na di highest for di show history, and don raise di stakes for wetin dey expected to be anoda ogbonge season, di organisers tok.

BBNaija na one of di most anticipated television shows for Nigeria. Dis na sake of di category of pipo wey dey watch am pass - most of which na young pipo.

Di show dey usually dominate conversations for social wen e start up until di end.

Speaking ahead of di new season, di Executive Head, Content and Channels, West Africa, MultiChoice, Atinuke Babatunde say di show go build on dia legacy wit bigger surprises.

"Season 11 go build on dat legacy wit even bigger stakes, fresh twists plus exciting mix of housemates wey go keep audiences engaged from premiere night through to di finale," Babatunde tok.

On who di housemates of BBNiaja season 11 go be, di organisers neva unveil dem. But dem reveal Ebuka Obi-Uchendu as di returning host for di show.

Preparations for di new season bin start earlier dis year wit physical auditions wey hold from 22 - 24 May for Lagos, Abuja and Enugu, afterwards dem invite applicants wey dey shortlisted.

Participation dey free and open only to Nigerians wey dey di age of 21 and above wit valid means of identification.

Di new season follow di success of BBNaija Season 10, wey end on 5 October 2025, as Opeyemi Ayanwale, wey pipo sabi well-well as Imisi, beat 28 other contestants to win di prize package worth ₦150m, wey include ₦80m in cash plus SUV.

Meet all di BBNaija season 11 housemates

  • Tram - Di 24-year-old guy na Lagos-born streamer and content creator. Tram goal for di BBNaija house na to play di game.
  • Temi Nkem - Dis na 21 years old Delta-born, London-raised chatterbox wey come into di house wit London pepper.
  • Martins Iye 'Martins' - E be from Kogi state wey love Basketball. E be 30 year old visual storyteller and model
  • Ayoola Abisola 'Abi' - She be model and chef from Osun State. She dey enta di BBNaija house wit energy, she don marry and she be 25 years old.
  • Chimsom Chuka - Dis na 27-year-old pharmacist from Anambra state.Chisom enta di house wit plenty steeze for hand.
  • Keivo - As normal guy na, e be from Benue state. Keivo na 27-year-old web developer and e dey bring self-confidence to di house.
  • Mercedes - Well dat na her name, and she be 26 years old. She be Delta-born entrepreneur, massage therapist and concierge CEO.
  • Uzoma Kamsiomachuckwu 'Kamsy' - Kamsy na stylish 24-year-old event planner, gift curator, and decorator from Imo State wey dey live for Lagos state. She dey dramatic.
  • Obanikoro Sultan 'Sultex' - Dis guy na 24-year-old dancer and choreographer from Lagos. Im relationship status dey complicated but e love gaming, dancing, playing table tennis and football.
  • Aikou - Dis guy na book lover and and deep thinker. Di 25-year-old Aikou na from Abuja, e be freelance teacher and web developer.
  • Flora Egbedi 'Flora' - Dis na makeup studio owner from Delta state. She dey confident, fashionable, and hardworking. She say she dey bring beauty and energy to di house.
  • Isabella Imoh 'Bells' - Bells as she like to call hersef na 22-year-old undergraduate from Akwa-Ibom wey grow up for Lagos. She still dey love wit someone wey she meet for high school and she be foodie.
  • Gerard Edebija 'Gerard' - Dis na multi-talented 23 years old guy. Gerard na Lagos-based on-air personality.
  • Oshinkoya Oyindamola 'Oyin' - Na real confam babe from Sagamu, Ogun state wey enta di house wit ginger. Oyin na 22-year-old sales entrepreneur from Ogun State she be model and she fit appear rude at first, but she dey friendly and funny.
  • Faith Gamdi 'Sheba' - Sheba na fitness-loving mom, proud mother, and certified lover girl wey enta BBNaija house for good times.
  • Araga - Dis 29 years old guy na fashion model. Im mission na to get di money and drop some energy for di house.
  • Ricky - Dis guy na 33 years old from Port Harcourt. E be writer and e love to bring energy to di house.
  • Nomy- She be 26 years old and she be fashion designer from Anambra state. She come wit plenti vibes and she dey charming.
  • Barry - Dis 26 years okd guy get style wit standards. Barry na civil engineer and Abuja-based fashion designer wey dey dress to win and open to love, especially wen e lead to marriage.
  • Neche Maduagwu - She be 25-year-old lawyer from Anambra state. She say she fit dey gentle for face but she be confam choko.
  • Yusuf Muhammad - E be 25-year-old Yusuf from Kogi state wey dey ready to tell im story and show off im creativity. E be actor, writer, model and farmer wey dey single and ready to mingle.
  • Goddessa - She be 30-year-old musician from Abia State wey dey live for spontaneous moments. She no dey find love for di house.
  • Usaku Keren Bantai 'Bluethopia' - She 22-year-old from Adamawa State. Bluethopia na photographer, model and student ans she step into BBNaija wit authentic style.
  • Nwosu Cassi - Dis na young hustler from Abia State. Cassi na 27-year-old entrepreneur and actor. E dey multitalented, e fit draw, paint, and practice chiropractic therapy.