You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
South Africa warn against door to door search of migrant documents as Ghana evacuate anoda 1,000 citizens
About 1000 Ghanaians wey dey live for South Africa dey expected to land Accra Ghana on Sunday, 26 July and Monday, 27 July, as part of govment effort to evacuate dia citizens from di rainbow kontri sake of anti-immigration protest.
Dis dey come as South Africa govment warn groups wey dey conduct door to door search of foreigners documents to stop, as e dey affect dia work.
On Saturday, Ghana minister of foreign affairs Sam Okudzeto Ablakwa for statement announce say dis latest evacuation phase go be in groups.
"Dis evacuation exercise na for pipo wey don already register wit di Ghana High Commission for Pretoria to voluntarily leave di kontri," di minister tok.
E say dem no go abandon any national wey wan comot for South Africa and leave am for di way of harm.
"Di govment of Ghana and our high commission for Pretoria remain alert and don reactivate dia emergency consular response as we tanda ready to assist all Ghanaians wey dey live for South Africa to return home safely."
For June, di kontri bin repatriate nearly 1,000 pipo South Africa sake of xenophobic attacks and harassment against African nationals.
Ghana be one of di first kontris wey begin to repatriate dia citizens afta fresh wave of attacks for South Africa.
End of Di one wey oda users dey read well well
Later, Nigeria, Zimbabwe, Malawi, Ethiopia, Kenya and oda kontris follow for di repatriation exercise to evacuate dia citizens from di kontri.
Between 14 June to 24 July - South Africa don process and deport ova 60,000 foreign nationals
Chairperson of di Inter-Ministerial Committee on Migration, Nkhensani Mmamoloko Kubayi tok say between 14 June to 24 July, dem don process and deport a total of 68,138 foreign nationals of various nationalities.
She announce di informate on Sunday, 26 July during one press briefing to update South Africans on how di govment dey implement di 'Five-Point plan' to strengthen migration management for di kontri.
Kubayi say majority of di nationals dem process for di point of repatriations na Malawian nationals, followed by Zimbabwean and Mozambican nationals.
On di arrest of illegal migrants and businesses wey employ illegal migrants, di South Africa govment say law enforcement authorities don register three hundred and fifty four (354) cases of arrests and prosecutions against individuals wey go against di law wey relate to di issue of migration.
Also, last week police arrest anoda additional sixty nine pipo for Jeffrey Bay and dem go appear for court on Monday, 27 July.
Di IMC say since 1 April to di end of June, di immigration courts don finalist 28, 736 immigration related cases mainly for deportations.
'Stop door to door search of foreigners documents'
Di south African govment also warn groups wey dey carry out door-to-door checks of foreign nationals documents to stop as e dey interfere wit dia work.
Di IMC Chairpesin say instead make dem report dia concerns to law enforcement and allow police to do dia work
"We don observe say some individuals dey wey impersonate Home Affairs officials and target foreign nationals and some businesses for these illegal identity searches and sometimes extortion.
"We want urge whoever dey involved for dis wrong practice to stop or face di might of di law."
Kubayi say police bin arrest seven pipo wey dey carry out dis illegal act and warn dos wey dey involved to stop.
Di state govment also confam di death of one foreign national for Bellview few days ago as enforcement authorities dey carry out dia duties.
According to di IMC, e bin dey "resist lawful operations and dey confront law enforcement officers."
Although, dem no name di person, but di IMC say Independent Police Investigative Directorate dey investigate di mata and dem go make di report public.