You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Why Chad join Mali, Niger and Burkina Faso to announce withdrawal from ICC
Chad don announce dia decision to withdraw from di International Criminal Court (ICC), months afta three oda sahel kontris announce dia own withdrawal.
Chad under dia leader Mahamat Déby say dia decison na based on wetin dem describe as existing biases for di functioning of di court.
For dia statement wey dem issue on Monday, Foreign Affairs Ministry tok tok pesin Ibrahim Adam Mahamat say im govment don formally notify di UN Secretary General, wey dey also serve as depositary of di Rome Statute, of di planned withdrawal.
For September 2025, three West African kontris announce withdrawal from di International Criminal Court (ICC).
Burkina Faso, Mali and Niger announce dia decision to withdraw from di ICC wit immediate effect.
Na June 2026, Niger officially submit request to withdraw from di ICC, nine months afta dem announce dia intention to comot.
Dem allege say di judicial body na tool for "neo-colonialism" and dem dey practice "selective justice".
E dey clear say di Central African nation decision dey follow similar move di three junta-led Sahel nations of Mali, Niger, and Burkina Faso.
Why Chad dey withdraw from ICC
Chad say dem dey comot from ICC becos of how di court dey handle some prosecutions especially for African kontris.
"Dis decision na di result of thorough review of di functioning of di International Criminal Court since e come into operation for 2002, as well as dia overall record, wey dia effectiveness remain limited and uneven in relation to di expectations wey accompany dia creation," e state.
Specifically, di Foreign Ministry tok tok pesin mention say dem perceive selective approach towards prosecution, as wetin e call bias against African kontris.
Di statement note say most of di ICC investigations, detentions and judicial activities dey concentrated on di global south, especially for Africa.
"Such kontris and populations increasingly view dis as form of political instrumentalisation of di ICC," di tok tok pesin say.
E also add say make di African Union reflect on ways to strengthen di continent judicial mechanisms wey respect African and national sovereignty.
Although dem plan to withdraw from di 125-member court, Chad say dem go kontinue to fight impunity for perpetrators of di most serious crimes.
While di kontri dey confam say e don inform di court of di Sahel states' decision to withdraw, di ICC say dem dey "undermine di collective pursuit of justice and weaken global efforts to end impunity."
Di ICC dey created to end impunity for international atrocities such as genocide, war crimes, and crimes against humanity.
Howeva, dia function come under criticism ova years.
Di court dey currently struggle wit di withdrawal of some of dia members and search for new chief prosecutor sake of di dismissal of Karim Khan.
Wen Chad withdrawal go take effect
According to di Public Affairs Unit of di International Criminal Court ICC response, dem refer to Article 127(1) of di Rome Statute, wey state say di withdrawals go take effect one year afta di date wey dem receive di notice of withdrawal.
Di ICC tok say even though to join or comot from di treaty na sovereign right and decision from di kontri under international law, dem dey always regret any decision to comot from di collective effort to end impunity for di most serious international crimes.