You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Wetin we know about collapse of students hostel for Oko
- Author, Gift Andrew
- Published
- Read am in 2 mins
Building collapse happun on Sunday midnight into Monday for residential area for Oko Anambra state.
Elite lodge wey be three story hostel dey house plenty students of di Federal Polytechnic Oko before e go down for midnight.
Tori be say many of di residents dey sleep wen di incudent happun.
E Neva clear how many casualties dey affected but tori be say some students been dey trapped inside di rubbles wen di building go down.
Eye witness for di area say dem hear loud noise before di collapse happen. Dem say dem hear cry of pipo wey dey cry for help from di rubbles.
Anoda eye witness say di house bin dey sink before e finally go down.
Due to say di area na local place, emergency agencies no too show face on time wey make locals join hands begin rescue victims from di rubbles.
As at time of dis tori excavators still dey push through di rubbles to check for trapped victims and survivors.
Though heavy rain dey fall, emergency teams still dey do dia work to ensure say dem save any pesin wey still dey trapped inside.
Our reporter wey visit di location say di pipo for di area believe say more pipo still dey trapped or killed inside di rubbles.
Police for di state say dem dey work wit oda emergency agencies don rescue some injured victims and send dem to hospital wia dem dey collect treatment.
Building collapse na big menace for Nigeria and most Africa kontris as e don lead to loss of plenty lives and destruction of properties worth billions of dollars.