Di tallest man for Ghana wey popular as 'Awuche' don die

Published
Read am in 3 mins

Di tallest man for Ghana, Abdul-Samed Sulemana aka Awuche, don die.

Di 9.6 feet giant wey bin suffer one medical condition wey dem call 'gigantism' die on Monday 27 July for hospital, according to im family.

For 2023, Awuche bin appeal for public support for medical care - three years later one philanthropist bin offer to fund im medical treatment.

Oga Ibrahim Mahama for July dis year dey reported to cover medical bills for im spinal issues and chronic ulcer wounds.

Tok-tok pesin for Ibrahim Mahama di philanthropist for 11 July give update for di treatment im dey receive.

Rafik Mahama tok say "I bin engage wit medical team for Tamale Teaching Hospital afta dem assess im condition wey dem confam say dem no go cut im leg as dem plan bifor."

"I wan assure Awuche im family say oga Ibrahim Mahama go continue to support im treatment and cover di bills. We wish Awuche successful treatment and smooth recovery."

But weeks afta dis post, family of di 32-year-old don confam say im don die.

Awuche tok BBC News Pidgin for 2022 say im dey grow tall every three or four months

Inside one exclusive interview wit BBC Pidgin for 2022, Awuche say im wake up one day for 2015 to realise say im tongue bin make big inside im mouth wey im no ft to breathe well.

Dat be di time im life begin to change.

"Every three or four months, I dey grow tall. My height don make I become famous", im tok BBC Pidgin for im house for Gambaga for di Northern part of Ghana.

Awuche tok at di time say whenever im show up for events, pipo dey wan come close to am, im become local celebrity.

Awuche bin suffer from 'gigantism' wey make im bone grow tall.

"Doctors tok me say dem gatz comot sometin inside my head wey make I bin dey grow tall, to stop di growth."

Even though di extreme height affect im quality of life, Awuche tok BBC pidgin at di time say im get hope to marry and born children.

"Dis be how Allah bin create me."