Gunmen attack community for Kaduna, kpai 30 pipo including children for midnight

Wia dis foto come from, Kafanchan Catholic Diocese
At least 30 pipo, including about seven children, don kpai as gunmen attack Chawai community for Kauru local govment area of Kaduna State, for early dis Monday morning.
One catholic priest wey dey work for di community tell BBC Pidgin say dis no be di first time wey dem go face attack like dis inside dis 2026.
Fr Mark Bisan na di Parish Priest of St Monica Catholic Church, Ikulu Pari, wey dey service St Kizito outstation Naridon wia di attack hapun, and e describe di attackers as Fulani.
Di attack start around 12 midnight as pipo start to dey hear gunshots anyhow and di attackers kick open pipo doors and kpai dem wia dem dey sleep, Fr Bisan tok.
Priest narrate how di attack happun
One army checkpoint dey close to di community wia di attack hapun and according to di priest, dem suppose hear di gunshots.
"But even wen di community pipo call dem for phone, dem tok say dem dey come but na until 7am dis morning bifor dem arrive," Fr Bissan tok.
"Dis community bin no get any wahala wit Fulani herdsmen so we no fit tell why di attack hapun. Na quiet community wia di pipo dey conduct dia business in peace."
One family lose about five children for di attack. Di priest tok say dem don deposit 28 bodies for Zango mortuary, but di family of two of di victims don bury dia own pipo.
Fr Bissan tok say e believe dis na targeted attacks against di majorly Christian community.
"Last month, I bury nine of my parishioners (for Ikulupari), and dis one na di third of attacks like dis for our community dis year alone," e tok.
"Afta each attack, we no go hear anytin from di govment, wen di state govment or d local govment come, dem no go tok to us. Di military no go tok to us. Di community go just bury dia dead and kontinue as if notin hapun."
"My parish don dey attacked many times. Dem bin kidnap my predecessor for di parish two years ago and later release am, but dem kill di pesin wey bin dey live wit am.
"Since I resume here, dem don attack di parish at least two times. Na God dey save me say I no dey house, but dem destroy my house and damage plenty tins for di parish."
Di BBC don contact Di tok-tok pesin of di Kaduna Police Command and di State govment, but dem neva respond.
BBC News Pidgin see fotos of dis Monday attack, fotos of di deadibodi of children and women wey community pipo cover wit fresh leaves.
Di pictures dey too graphic to publish.
Di southern part of Kaduna State na one of di areas wey don witness violent attacks by armed attackers for di northern region of Nigeria ova di years.
Similar attacks dey also hapun for States like Plateau, Benue and Nasarawa.
Many bin believe say di cause of dis crisis na misunderstanding betwin farmers and herders, but as time dey go on, di issue don dey bicom more and more religious mata.
Di Nigeria govment bin don deny allegations by di US President Donald Trump say dem dey allow di genocide of Christians for di kontri.

Wia dis foto come from, Kafanchan Catholic Diocese









